Friday, 21 August 2015

wazobia fm news

News
one group of men wey carry gun inside Guatemala don kill 11 people
Una World News
Monday, 09 September 2013 10:19
alt
For obodo oyibo tori, one group of men wey carry gun inside Guatemala don kill 11 people, come still wonjor like 15 inside one attack 4 one restaurant inside d town wey be San Jose Nacahuil. Report say dem see some of the people way die after them try to hide 4 d restaurant bathroom and oda areas. Informate never clear wetin make d bad men do dis attack, but Olopa 4 Guatemala don already dey chook eye 4 d mata to know the criminal gangs wey do d badness.
 
Presido Goodluck Jonathan don talk say he dey very very worried for the level of security badness in
Nigeria Tori
Monday, 09 September 2013 10:16
alt
Presido Goodluck Jonathan don talk say he dey very very worried for the level of security badness inside d country, say if care is not taken, the wahala go really affect him join body group and friends plus partners of obodo Nigeria. Oga Jonathan do dis talk during by the time of yesterday 4 d opening ceremony of the number 2 sit down discuss join body meeting of all Nigeria Catholic Bishop’s Conference wey shele inside Otukpo, Benue State. Oga Senate Presido, David Mark wey represent Oga Presido, talk say Oga Presido Jonathan talk say he dey very concerned on top how any how person dey get access to weapons, say even people wey get in mind to do badness, don dey get training on top how to use weapons, say even people wey get in mind to do badness, don dey get training on top how to use weapon.
Read more...
 
Israel don release 26 Palestine prisoners as part of agreement wey go start peace sit down discuss t
Una World News
Wednesday, 14 August 2013 10:44
alt
Israel don release 26 Palestine prisoners as part of agreement wey go start peace sit down discuss today. In formate be say the buses wey carry d prisoners drive dem from d prison wey dey central Israel, com carry dem go Beitunia checkpoint  4 west bank and Erez wey cross with gaza. Oga presido 4 pPakistan , mahmoud Abbas greet d 2 risoners wey dem sent to West Bank while plenty crowd welcome d remaining 15 inside Gaza. Report say Israel and Palestine representatives go start face to fac sit down discuss inside Jerusalem after three years of long silence.
 
 
Lagos State Government don march go Ogbonge High Court to request against d judgement of d Court of
Lagos Tori
Wednesday, 14 August 2013 10:40
alt
Lagos State Government don march go  Ogbonge High Court to request against d judgement of d Court of Appeal Lagos, wey release oga Hamza Al-Mustapha and Lateef Shofolahan wey dem accuse say kill Madam Kudirat Abiola, the wife of  June 12, 1993 Presido election winner, Oga MKO Abiola. Oga 4 law inside Lagos, Ade Ipaye 4 one discuss yesterday say dem get good reason to stand against d release. Oga Ipaye add say him join body group file two separate notice of appeal against the judgement during by d time of Monday.
 
Federal Government and ASUU sit down discuss join body meeting by d time of yesterday inside Abuja
Nigeria Tori
Wednesday, 14 August 2013 10:36
alt
D private sit down discuss join body meeting wey shele between Federal Government and ASUU during by d time of yesterday inside Abuja, no end well at all. But oga Governor 4 Benue State, Gabril Suswam wey still be d oga chairmo wey dey chook eye 4 University needs, talk say the two groups don reshift dem arrangement deal to August 19, 2013. Oga Suswam wey be d person wey dey negotiate 4 Federal Government add say dem don get progress 4 d negotiations.
Federal Government talk say dem no get the resources to meet d 92billion naira money wey ASUU join body group dey ask for. Oga 4 money, Ngozi Okonja- Iwealaduring by d time of d opening of one two days join body meeting of big oga’s 4 money mata and accountants inside State, say d money wey ASUU dey ask for no dey within d reach of Government. She add say obodo Nigeria don reach stage where be say different join body groups go ask for plenty money and if dem carry d money give dem, dem no go do any work. She finally say d country still dey suffer from d badness of d salary wey dem increase during by d time of 2010.

No comments:

Met Police issues mugshots of London's most wanted suspects in time for Christmas

Met Police issues mugshots of London's most wanted suspects in time for Christmas Police are hoping to catch a number of suspects...