For obodo Oyibo tori, before South Africa Presido Nelson Mandela dey ready to spend him 95years birt
Una World News
|
Thursday, 18 July 2013 11:38 |

For obodo Oyibo tori, before South Africa Presido Nelson Mandela dey
ready to spend him 95years birthday 4 Pretoria Hospital, as Ceremony dey
shele 4 obodo d world and South Africa. The South African people don
already arrange for better Charity goodness wey dem go do 4 Oga Mandela
enta Hospital sake of Lung infection. Meanwhile, Oga Mandela daughter
Zindzi come outside yesterday come say her Papa don dey progress 4
hospital. |
Federal Government don tell tori people say make dem no put eye or even listen to d badness wey Mush |
Nigeria Tori
|
Thursday, 18 July 2013 11:36 |

Federal Government don tell tori people say make dem no put eye or even
listen to d badness wey Mushin I no gree group, Boko Haram dey do. Oga 4
informate, Labaran Maku wey do dis talk, say since Boko Haram dey plan
na to put fear 4 every Nigerian mind, come still bring doubt to d work
wey security join body group dey do, say everything dey 4 tori people
hand now to make sure dem avoid d group. Oga Maku finally add say time
don reach 4 tori people to reduce the kind space and time wey dem give
Boko Haram.
|
Read more...
|
Oga 4 olopa, Charlie Beck say criminal act no go dey tolerate. |
Una World News
|
Wednesday, 17 July 2013 10:08 |

For obodo Oyibo tori, olopa 4 Los Angeles dey prepare to gather in full
force, so dem go stop any new disturbance sake of d release of one
Florida Security man wey kill one 17years old boy. Oga 4 olopa, Charlie
Beck say criminal act no go dey tolerate. Informate be say 29years
George Zimmerman got release paper during by d time of Saturday sake of d
death of one 17years Trayvon Martin wey die during by d time of
February 2012. Oga 4 civil rights, Al Sharpton say him go lead one I no
gree waka 4 Trayvon Justice inside 100 cities to take ask 4 Federal
Civil Rights charges against Oga Zimmerman. |
Presido Goodluck Jonathan say Nigeria Kajad response to plan 4 HIV/AIDS |
Nigeria Tori
|
Wednesday, 17 July 2013 10:06 |

Presido Goodluck Jonathan say Nigeria Kajad response to plan 4
HIV/AIDS na beta opportunity to put obodo Nigeria back towards achieving
obodo d world collabo. Presido Jonathan do dis talk when him discuss
with tori people after d confirmation of announcement of d special join
body meeting of d African join body group 4 HIV and AIDS, Tuberculosis
and Malaria. He add say research and development don start 4 medicine
area inside African countries plus including Nigeria.
|
Read more...
|
Oga d law 4 USA, Eric Holder say dem go still continue the torchliting of d death badness of 17years |
Una World News
|
Tuesday, 16 July 2013 11:58 |

For obodo Oyibo tori, Oga d law 4 USA, Eric Holder say dem go still
continue the torchliting of d death badness of 17years old Trayvon
Martin. He say d country go use dis opportunity to speak dem mind about d
issue and wahala wey d case don start. Na during by d time of last year
na im court department open d case mata about d death of d Black boy,
Trayvon Martin. Meanwhile, na during by d time of last week Saturday na
im court clear George Zimmerman wey shoot d boy, come claim say na self
defence during by d time of Februaary, 2012. |
No comments:
Post a Comment